Wednesday, 18 February 2015

Boko Haram Kill 38 Pipo for Northeast Naija



 
=According to Tori, na more dan 38 pipo naim don die from two
suicide attack for the Northeast side of Nigeria, wey no reach six weeks before the General Election for the Country, as the Leader of Boko Haram don Promise say, dem go spoil the election.

Boko Haram wey bi the cause of why dem Postpone the election from February 14th wey e suppose happen go March 28th, and some officials don tok say, e go good make Army tackle dis mata for that area as na only dem go fit Stop Boko Haram, to dey kill pipo anyhow.

Dis one wey happen soo, don show the serious challenge wey Nigeria and neighbouring countries like Cameroon, Chad and Niger dey face, even as dem dey claim sey, dem succed for the joint operation wey dem start dis month.

Boko Haram Leader, Abubakar Shekau, for one new video tape wey
dem release for twitter, tok say, no Election go happen even if dem don die.

Niger President, Mahamadou Issoufou, don swear say, ein country
go make sure say, dem end the work and plans of Boko Haram, wey die gbege for 6 years don kill more dan 13,000 pipo already.

Ein tok for Niamey wey bi dia capital City say, Niger naim Boko
Haram go for Die.

But with all the shout and fight, pipo still dey wonder weda, Boko
Haram go fit really die at-all.

No comments:

Post a Comment