Tuesday, 24 February 2015

FIFA Don Get Advice to Play 2022 World Cup for NOV&DEC

Image result for 2022 fifa world cup



According to Informate, One FIFA Taskforce don recommend give the body say, make dem approve to play the 2022 World Cup for Qatar, for November and December.

Some of the Big Ogas for FIFA naim do meeting for Doha to tok ontop the mata, as dem dey fear say, if dem make up dia mind to play the competition for summer wey mean say the weather dey hot well-well for dat country, den the Health mata of Players and dos wey dey go the country during that time go get Coma.

The temperature wey Qatar dey get for summer dey pass 40 Degrees and for November and December, e dey reduce go 25 Degrees.

The Recommendation wey dem give today, go reach the FIFA executive committee meeting for Zuric on 19th and 20th of March 2015, for dem to discuss wetin dem go do ontop-am.

One of the Pipo for the taskforce, Chief Sheikh Salman Bin Ebrahim Al-Khalifa, con still advice say, make dem reduce the days wey dem go take play the 2022 FIFA World Cup Competition.

No comments:

Post a Comment