The Governor of Kano state, Rabiu Kwankwanso, don accuse the Governor of Jigawa State, Mallam Sule Lamido, wey follow dem wey be 5 Governors wey comot from PDP go join APC say, ein betray wetin make dem comot for PDP for the first place.
Kwankwanso wey do interview with news pipo tok say, truth no dey the rumour wey dey waka say, APC Presido candidate, Gen Buhari, no too well for body, to fit rule Nigeria.
Oga Kwankwanso tok say, the one wey the 5 Governors take pack comot from PDP show say, the party no be the monster wey everybody know as before again.
Ein tok say, Lamido na part of dem before as naim lead dem comot from the Party come carry dem reach one point, before ein con change ein mind for the last minute, wey shock dem well-well.
Ein con still tok say, Buhari health-mata no be problem, as the man no get anything wey dey worry-am for body, and ein dey very fit to lead Naija pipo.
Kwankwaso Tok say, ein no be Doctor oh! but from the time wey ein don sidon with the former Head of State, ein see am as person wey dey fit to do work as President.
<script type="text/javascript" src="http://s7.addthis.com/js/250/addthis_widget.js"></script>
No comments:
Post a Comment