One Video wey comot from dat Muslim Militant group, Islamic State for Iraq, don show 21 Kurdish fighters-dem wey dem catch.
The Video wey Al Jazeera see, bin don comot for like one week now, and naim be the second Video wey dem send comot wey show the number of Kurdish fighters wey dem don catch.
Inside the video, you go see say, the Kurdish fighters wey dem catch soo, wear orange jumpsuit, and dem con bow dia head small.
Dis vidoe dey comot after some days wey dem release video wey show 17 Kurdish fighters wey dem carry dey parade dem for the streets of Kirkuk, wey dey for Iraq.
Inside the video, ISIL Fighters dey tok put for the camera say, dem no get fight with Kurdish Muslim pipo, but na only Infidels and dia plenty agents naim dem get mata with.
Na the media adviser to the Ministry of Peshmarga, Halgord Hikmat, naim dey confam give Al Jazeera say, the video na real thing.
No comments:
Post a Comment