Thursday, 19 February 2015

Millions of China Pipo dey travel for Holiday



Image result for china holiday 
According to tori, plenty Millions of pipo for China naim dey travel now for the Lunar New Year Jolliment wey dem dey do every year, wey the World see as only time wey plenty pipo dey travel pass every year.

Xinhua news Agency don announce say, Na like 3 Billion pipo dey travel now for the 40-days travel period.

PidginDigest gather say, China dey celebrate with more public Holiday wey dem dey call “Golden Week” wey dey end for February 24th.

This Holiday wey dem know as “Spring festival” dey start with one big food wey be “Reunion Dinner” on Wednesday wey bi the New Years Eve.

No comments:

Post a Comment