Tuesday, 24 February 2015

NFF Don Arrange new Contract give Keshi

Image result for pinnick and keshi



The Presido of the Nigeria Football Federation (NFF), Amaju Pinnick, don tok say, the contract for Super Eagles coach, Stephen Keshi, wey everybody dey wait for don ready, and dem go soon send am go give am before the end of dis week wey we dey now.

Oga Pinnick wey tok to news pipo for Abuja tok say, NFF dey ready to finalize dis contract mata with Keshi, so ein go fit resume work as coach, if ein gree with the contract wey dem go send go give-am.

Ein tok say, no be say NFF dey try avoid make dem enter new contract with Keshi, but dem just want make everything dey clear between the coach and NFF, before dem do anything.

Ontop the mata say, Keshi wan go Burkina Faso to go coach their team for yonder, ein tok say, Keshi get ein right to choose where ein go for work, and dem no go hold am make ein no go do wetin ein make up ein mind to do with ein career.

Pinnick tok say, NFF don payy all the money wey dem dey owe Keshi and ein Assistants, so nothing like say dem still dey owe any person money.

Meanwhile, NFF Board go do meeting next week to take tok some of the problem wey dey face dem for the body, and how to make things easy for dem to fit do dia work wey dem don sign say dem go do well.

No comments:

Post a Comment