Friday, 20 February 2015

Ogun Traffic Corp don Promote 83 of dia Officer

Image result for Ogun state 


The Ogun State Traffic Compliance and Enforcement Corps don promote 83 of dia officers for the corps, so dem go fit dey more productive for dia work.
Na the Zonal Commander, TRACE for Ota, Ogun State, Mr. Ajibade Adekunle, naim tok dis one today Friday for interview news pipo for Ota wey ein for con dey explain say, those wey dem promote soo, na Officers and superintendent category, say, na for dem to continue to dey give dia best for the work wey dem dey do.
Ein say, dose wey dem promote na 50 men and 33 women, and some dem even come collect award for the serious work wey dem do for the work.

No comments:

Post a Comment