Monday, 16 March 2015

Boko Haram take Fire Bunr Pipo house for Bama Village


Image result for boko haram burn houses in bama

According to tori, dos boko haram group, don put fire for pipo house for bama village wey dey foir the south-east area of nigeria, wey don make plenty of the pipo for dat area run comot.
Dos wey see wetin happen tok say, di Terrorist bin don come warn di pipo for dat place on Saturday say, dem dey come Destroy dia house, and as dem come showface di next day wey bi Sunday, for di bama town wey bi 70 kilometres from maiduguri, to burn dia house reach ground.
 

Even as Nigerian army don dey do dia work to collect plenty of dos village from Boko Haram hand, wey don dey control dat side.
 

Tori say, plenty of the pipo run go Maiduguri wey bi di State Capital of Borno State, and where Boko Haram for get upper hand pass.
 

Dem say, dis one happen even as, Army don pursue di Boko Haram pipo from Boboshe and Yale village con dey go towards Bama now.
<script type="text/javascript" src="http://s7.addthis.com/js/250/addthis_widget.js"></script>

No comments:

Post a Comment