Friday, 23 January 2015

The New King of Saudi Arabia don enter Throne





Saudi Prince Mohammed bin Nayef (centre) at funeral of King Abdullah, 23 January 2015



The New King for Saudi Arabia, King Salman, don promise say, betament go continue for dia Kingdom.
King Salman tok dis one, after dem crown-am as King, after ein Half-Broda, King Abdullah, die for throne.

After dem crown-am, the new King just sharp-sharp, start to dey appoint who go be King after-am, Minister and even one Prince from the family wey dey rule under the third generation.


Mourners carry the body of King Abdullah, 23 January 2015


King Abdullah wey die soo, bin dey sick with lung infection for some weeks, and ein con die overnight yesterday.
The new King Salman wey bi 78 years, don promise say, ein time as King go continue with the plenty law wey the former king put for ground.



No comments:

Post a Comment