According to Tori, All the All progressive Congress Governorship Candidates, go visit Akinwunmi Ambode for ein campaign office wey dey for Lagos dis weekend wey just pass soo, to go announce say, dem ready to support-am to win the governorship election for lagos state, for February 28th 2015.
Dos wey go visit Ambode na, Vice Chairman Mr. Fola Tinubu, and Leaders like Chief Safari Adaranijo (Mobilisation), Dr. Kunle Wright (Finance), Drt. Solanke Labamba (Medical), Niyi Adelaja (Logistics), and Kehinde Bamigbetan (media and Communication).
The Chiarman of the Board of Trustees for di Ambode 2015 support Group, Sen. Tokunbo Afikunyomi, say, dem arrange the group to make sure say, pipo contribute wetin dem get to make the Party win the Election dis year.
Oga Afikunyomi con still tok say, di work wey the Party don do for lagos state pas wetin Federal Government don do inside Nigeria.
No comments:
Post a Comment