Monday, 2 February 2015

President Jonathan Don Dash Nollywood Money Again!



Jonathan-Entertainers6 

Nigerian President, Goodluck Jonathan, don arrange one Presidential intervention scheme, to take help improve the level wey Nigeria Movie Industry take be now.

The Project wey dem tag as “Project ACT Nollywood” wey just be like dat N3 Billion wey president Jonathan give Nollywood 4 years ago to help dem improve film Production.

Una go remember say, President Jonathan, bin do Private meeting with some important pipo for the entertainment Industry, for Lagos, for January 24th 2015.

We no quick know wetin dem tok for the meeting, but last week naim the Federal Government, launch the N2 Billion Innovation Distribution Fund (IDF), wey go dey to improve how dem take dey distribute Audio-Visual content, and stop Piracy for our Country-Nigeria.

No comments:

Post a Comment