Police don announce on wednesday say, 2 British technicians get serious injury as the stunt wey dem bin dey try do for the set of the James Bond film "Spectre" fail for Austria Alps.
According to informate, one car naim crash enter one platform for the set on Tuesday, wey pin one of the technician join the platform, dem con trowey the oda man comot.
na Helicopter naim dem take rush the 2 of dem comot go Hospital, and the 3rd one con collect treatment for the set, as ein injury no plenty.
Tori say, the crew bin don dey shoot the Film since early January dis year, and dis number 24th film of James Bond "spectre" go comot later dis year.
No comments:
Post a Comment