The Nigeria Association of Nigeria Students (NANS), don tell the leaders of the National Youth Service Corps (NYSC), say make dem reduce the N4000 wey Corpers take dey do Online registration go N3000.
NANS tok say, no be because say dem want make dos wey go soon serve our country, come dey use am as opportunity to take chop pipo money anyhow.
NANS Presido, Comrade Tijani Usman, naim dey tell newspaper for Abuja after the meeting wey NANS do with NYSC pipo say, dem go start to dey monitor the online platform, to make sure say, e dey work well-well and dem no use am take dey tiff money from pipo.
NANS come tok say, dem no need to go back to dey do all dat old-skool call up letter, as e too cost and very risky.
No comments:
Post a Comment