One Suicide bomb attack don kill more dan 13 people for Potiskum, the north-east area of Nigeria today.
Tuesday, 24 February 2015
BREAKING NEWS: Suicide Bomb Blast for Bus Station Claim 13+
One Suicide bomb attack don kill more dan 13 people for Potiskum, the north-east area of Nigeria today.
FIFA Don Get Advice to Play 2022 World Cup for NOV&DEC
According to Informate, One FIFA Taskforce don recommend give the body say, make dem approve to play the 2022 World Cup for Qatar, for November and December.
IS Militant don Kidnap More dan 90 Christians for Syria
Dat Islamic State (I.S), don kidnap plenty Assyrian Christians from different villages wey dey the north-east side of Syria.
NFF Don Arrange new Contract give Keshi
The Presido of the Nigeria Football Federation (NFF), Amaju Pinnick, don tok say, the contract for Super Eagles coach, Stephen Keshi, wey everybody dey wait for don ready, and dem go soon send am go give am before the end of dis week wey we dey now.
Terrorist don dey hide con Dress like Women for Northern Nigeria
The Defence Headquarters don tok dis week wey e dey soo say, as dem dey do everything to flush out all the members of dat Boko Haram Group comot from Naija, dem don see say, some of the terrorist dey dress like woman, wey no go make pipo fit quick know dem well.
APCPCO Say Government Wan show Naija Pipo Fake Boko Haram Leader
The APC Presidential Campaign Organization (APCPCO), don comot con tok say, the office of Oga Presido Jonathan, dey plan to come show us fake Boko Haram Leader, to take show say, dem dey win the terrorist group for our country.
Jonathan Don dey beg PDP Lawmakers
President Goodluck Jonatha, don beg dose member of PDP for House of Representative, wey dey vex right now say, abeg make dem forget any quarrel wey dem get, but try work with-am to win the March 28th Presidential Election.
FG tok say Bird Flu no dey Obasanjo Farm
Federai Government don comot con tok yesterday say, nothing like Bird Flu dey for Obasanjo Farm wey dey for Otta, Ogun State.
Gov. Kwankwaso Squeeze Face give Gov. Sule Lamido
The Governor of Kano state, Rabiu Kwankwanso, don accuse the Governor of Jigawa State, Mallam Sule Lamido, wey follow dem wey be 5 Governors wey comot from PDP go join APC say, ein betray wetin make dem comot for PDP for the first place.
Group say Buhari no fit stop Corruption as President
One group wey dey support President Jonathan, Jonathan and Gboyega Youth Movement, wey dey for Ogun state, don tok say, the presido candidate of All Progressive Congress, Gen Muhammadu buhari, no be person wey Naija pipo go fit trust to fight corruption for inside Nigeria if ein win the Election.
Monday, 23 February 2015
Jonathan no gree sign paper with Yoruba Leaders
PidginDigest don dey hear now say, President Goodluck Jonathan, no go gree sign any agreement with Yoruba Leaders ontop the General Election wey dey come for March next year.