The
academic staff union of university (asuu), don hala comot say, di federal
government neva gree release the N1.3 trillion, wey suppose dey to take wake-up
all di university-dem for our country.
Di
chairman of asuu for university of ibadan, prof segun ajiboye, naim tok dis one
for di 63 post graduate school interdisplinary discourse wey dem do on saturday
say, dis one show say, our government no get truth for mouth, even after dem
release the first money for 2013, dem neva fit do anything again even till now
wey the first 3 month for 2015 don pass.
Ein
tok say, na the truth wey no dey for the mouth of government for nigeria, naim
make di union don do 19 serious strike for our country since 1992 con reach
2013.
The
national president for Asuu, dr nasir fagge, tok say, wetin make dem dey strike
for 21 years now, na say, government no dey eva do wetin dem promise say dem go
do for dem.
No comments:
Post a Comment