The
secretary of peoples democratic party for south-west area, chief adepegba
otemolu, don deny wetin pipo dey tok say, ein collect plenty dollars from
president goodluck jonathan, and ein no gree release di money give the 746
coordinator-dem for di campaign group for ogun state.
di
coordinator-dem wey comot from 236 ward for the state, bin gather for one
meeting to take let dem know wetin to do, but all of dem just start to dey
provoke as oga otemolu and the national auditor for di party, fatai adeyanju,
con announce give dem say, the money wey dem suppose take hounour all of dem
neva ready.
Di
coordinator wey dey vex, con hold the 2 of dem hostage for 4 hours and as the 2
of dem try to comot from the place, naim dem rough-handle dem any, dem con even
scatter the honda pilot jeep wey otemolu carry go di place.
Di
coordinator dey vex say, dem see reciept of n1 million for food and drinks for
di hotel, but nobody see the food abi the drink collect for the seminar.
No comments:
Post a Comment