Monday, 16 March 2015

Federal Neuro-Psychiatric Hospital worker don start strike for Enugu

Image result for Federal Neuropsychiatric Hospital enugu

Tori tok say, workers for the Federal Neuro-Psychiatric Hospital, fnh, wey dey for Enugu, don do peaceful protest and dem con give 21-day warning to the management, make dem settle the poor welfare package or dem go do dia worst, wey fit spoil work.
The workers wey dey protest, dey under the Joint Health Sector Union (JOHESU) bin march around the di compound of di Hospital with placards even as di board for the hospital dey do dia Board Meeting.

Di workers con dey sing say, make dem “pay dia nurses dia uniform allowance,” “pay dem dia teaching allowance” and dem dey cry for help from ministry of health and nigeria president.
 

As dem carry wetin dem want give Di Chairman of di Board, Chief Acho Nwakamma, Chairman of JOHESU, FNH chapter, Comrade Ejimadu Alozie, con dey warn dem say, if dem no meet wetin dem want by the time wey dem give soo, the workers go start serious strike for the hospital.

No comments:

Post a Comment