The sultan of sokoto, alhaji muhammad sa’ad
abubakar iii, don tell security angency-dem say, make dem make sure say, dem
give enuff security to dose youth corpers wey go follow help arrange the
general election for our country.
Ein con still advice youth corpers say, make
dem no use the problem for other election for past take tok say, dem no go
follow do anything dis time, as na service to dia papa land naim dem dey do.
Abubakar tok say, make dem do dis election
work with all dia heart, and make dem no follow the mouth of any political
party to take cause problem.
No comments:
Post a Comment