The Governor of Osun State, Mr. Rauf Aregbesola and the Candidate of the Peoples Democratic Party (PDP) for Osun East Senatorial District, Mr. Francis Fadahunsi, don start to dey accuse dem sef say, dem get hand for di political problem wey happen for Ilase and Ibokun inside obokun local government area of the state last week friday.
The Governor wey give statement thru ein tok-tok person, Mr. Semiu Okanlawon, tok say, dos Agbero boys wey dem suspect say dey work for Oga Fadahunsi, start to dey cause serious problem ontop members of the All Progressives Congress (APC) for ilase as Governor Aregbesola go pay homage give di Ruler for ilase.
Fadahunsi, wey bi Indigene of the town, dey contest against the Candidate of the APC for the Senatorial District, Mr. Jide Omoworare.
Aregbesola say, belle no sweet-am even as one woman member of dia party bin wound as di boys use cutlass take cut her ear.
No comments:
Post a Comment