Even as e bi say, Na just two weeks to the March 28 Presidential and National Assembly Elections, no be small overnight fire naim catch the warehouse of the Independent National Electoral Commission (INEC), wey dey for di Electoral Institute Along Abuja Airport Road.
Meanwhile, INEC don promise say, dis fire no go affect anything for the Election wey dey come soo, as dem dey assure Nigerians say, na only the materials wey dem use for the 2011 Elections naim the fire burn reach ground.
Na the INEC Director Security Directorate, Shettima Ngiladar, and the Fire Commander, Fidelis Iroegbu, naim dey tell news pipo for the place wey fire for catch soo say, nothing wey dem wan use for the 2015 election dey for where fire for catch soo.
Ontop how the fire wey tey for like 3 hours take start, oga iroegbu tok say, na electrical fault naim cause-am, as dem take bring light for that area.
No comments:
Post a Comment