The New King for Saudi Arabia, King Salman, don promise say, betament go continue for dia Kingdom.
Friday, 23 January 2015
The New King of Saudi Arabia don enter Throne
The New King for Saudi Arabia, King Salman, don promise say, betament go continue for dia Kingdom.
PDP for Imo State dey Decieve Jonathan:APC
The Campaign Group of Governor Rochas Okorocha of Imo State, don accuse PDP say, dem neva talk truth of wetin make dem wan really collect power for Imo state, even as dem dey lie give President Goodluck Jonathan.
Defence Headquarter don make dia website safe
According to informate from the Defence Headquarter wey dey for Abuja, dem don make dia website, wey bi, www.defenceinfo.mil.ng, safe from those people wey bin hack the website before.
Wednesday, 21 January 2015
Flying Eagles beat NDC Warriors 6 Kondo
The Flying Eagles for Kaduna on Tuesday, show say dem sef don step up dia Game, as dem con use ginger take dey prepare for the Super 6 Tournament wey go happen for Abuja dis weekend as dem use confidence win NDC Warriors 6 kondo.
INEC say na dem Get Ballot Boxes wey Police Seizee
The Police Command for Ogun State don tok say, INEC don Confam give dem say, na dem get the Ballot boxes wey some Sojas Seizee for Benin-Sagamu Expressway.
Thugs Attack President Jonathan Convoy
Some Political thugs go attack the convoy of President
Goodluck Jonathan, on Tuesday as dem carry dia campaign rally go Katsina State,
make Nigerian pipo to fit re-elect-am put for the Presido Chair again.
Ebonyi Civil Servants don Start strike
According to News, Civil Servants for Ebonyi state, don
start dia 3 days Warning today Wednesday, to take complain make Government
improve the condition wey dem take dey do dia work.
Bangladesh Police don Arrest 7,000 Protesters
Security pipo for Bangladesh say, dem don gbab more dan 7,000 opposition
activist, since dem start di protest wey dem dey do for yonder for some days
now.
Subscribe to:
Comments (Atom)