Monday, 16 March 2015

Tazania Police Don arrest Witchdoctors ontop attack on Albino Pipo

Image result for witch doctors

Tanzania Police don arrest about 225 traditional healers wey no get license, and soothsayers, as na special operation wey dem dey carry out for some parts if east africa, because of the attack and killing of albino Pipo.
Police spokesperson, Advera Bulimia, talk say some of the things wey dem see for the hand of the people wey dem arrest na: lizard skin, warthog teeth, ostrich eggs, monkey tails, bird claws, mule tails, and lion skin.
 

Ein also talk say, 97 of those wey dem arrest don already appear for court.
 

Tanzania President, Jakaya Kukwete, talk say, the attack against the albino people, wey dem dey use their body parts for witchcraft, say na big embarrassment for their Nation.
 

Report talk say, dem dey kidnap albino pipo to kill them, because dem believe say their body parts go bring luck.

No comments:

Post a Comment