According to tori, the nigeria police don dey do everything for dia
power to take rescue di emir of bukkuyum inside zamfara, alhaji mohammed usman,
wey some pipo kidnap from ein palace on friday night.
PidginDigest
We Think PIDGIN!!!
Monday, 23 March 2015
Fayose tok say APC No go fit Win Election for Ein State
The
governor for ekiti state, ayodele fayose, don tok say, di opinion poll no go
help di all progressive congress (apc), for the election wey go happen for
march 28th and april 11th 2015, as dem dey lie give dem
self.
ASUU Say Federal Government no Get Truth for Mouth
The
academic staff union of university (asuu), don hala comot say, di federal
government neva gree release the N1.3 trillion, wey suppose dey to take wake-up
all di university-dem for our country.
President Jonathan Promise say Election Date no go Change
According
to tori, president goodluck jonathan, don promise nigeria pipo say, the general
election wey go happen for march 28th and april 11th
2015, no go change.
One PDP Secretary for South-West Say Ein No Collect Money From President Jonathan
The
secretary of peoples democratic party for south-west area, chief adepegba
otemolu, don deny wetin pipo dey tok say, ein collect plenty dollars from
president goodluck jonathan, and ein no gree release di money give the 746
coordinator-dem for di campaign group for ogun state.
Sultan of Sokoto Say make dem Give NYSC Corpers Security During Election
The sultan of sokoto, alhaji muhammad sa’ad
abubakar iii, don tell security angency-dem say, make dem make sure say, dem
give enuff security to dose youth corpers wey go follow help arrange the
general election for our country.
Monday, 16 March 2015
Boko Haram take Fire Bunr Pipo house for Bama Village
According to tori, dos boko haram group, don put fire for pipo house for bama village wey dey foir the south-east area of nigeria, wey don make plenty of the pipo for dat area run comot.
Fire Burn INEC Warehouse for Abuja
Even as e bi say, Na just two weeks to the March 28 Presidential and National Assembly Elections, no be small overnight fire naim catch the warehouse of the Independent National Electoral Commission (INEC), wey dey for di Electoral Institute Along Abuja Airport Road.
Nyako don ask court make dem carry ein Case go back to Yola
One Former Governor for Adamawa State, Murtala Nyako, don tell di Judge of the Bauchi Division of the Federal High Court, Justice M.G Umar, make ein return ein court case, wey ein take dey Challenge why dem comot am from office for July 2014, go Yola Division, so dem go fit give di Judgement wey don already dey ground, ontop the case.
Governor and Senate Candidate for Osun State dey Accuse dem sef of Gbege
The Governor of Osun State, Mr. Rauf Aregbesola and the Candidate of the Peoples Democratic Party (PDP) for Osun East Senatorial District, Mr. Francis Fadahunsi, don start to dey accuse dem sef say, dem get hand for di political problem wey happen for Ilase and Ibokun inside obokun local government area of the state last week friday.
Federal Neuro-Psychiatric Hospital worker don start strike for Enugu
Tori tok say, workers for the Federal Neuro-Psychiatric Hospital, fnh, wey dey for Enugu, don do peaceful protest and dem con give 21-day warning to the management, make dem settle the poor welfare package or dem go do dia worst, wey fit spoil work.
Subscribe to:
Posts (Atom)