Security pipo for Bangladesh say, dem don gbab more dan 7,000 opposition
activist, since dem start di protest wey dem dey do for yonder for some days
now.
The Industry Minister, Amir
Hossain Amu, con dey tell news pipo for dia say, after ein sidon for one
meeting for Dhaka say, na more dan 7,015 people dem don fit arrest inside the
15 days wey di protest don start.
The protest start aspolice give
Zia office arrest, sake of say, she wan lead serious mass rally against her
political rival, wey bi the Prime Minister, Sheikh Hasina.
No comments:
Post a Comment