The Governor of Niger state, Babangida Aliyu, don tok comot
say, ein no go follow ein Deputy, Alhaji Ahmed Ibeto, fight or stop am to do
ein work as Deputy Governor, even as ein don go join All progressive Congress
(APC), from PDP wey ein dey before.
The Governor wey tok dis one on Tuesday as ein go collect
ein Permanent Voters Card (PVC), for Minna tom say, Oga Ibeto get ein right and
freedom to join any party.
Oga Aliyu con dey
advice Nigerians say, make dem make sure say dem collect dia PVC, and if dem
get any problem, na to re3port-am to INEC.
No comments:
Post a Comment