Wednesday, 21 January 2015

Thugs Attack President Jonathan Convoy

                      


Some Political thugs go attack the convoy of President Goodluck Jonathan, on Tuesday as dem carry dia campaign rally go Katsina State, make Nigerian pipo to fit re-elect-am put for the Presido Chair again.
According to informate, dem dey suspect say, the pipo wey do di attack dey loyal to General Muhammadu Buhari (Rtd), wey bi indigene of Katsina State.
President Jonathan convoy wey get, Vice Presido Namadi Sambo; PDP National Chairmo, Alhaji Adamu Mu’azu; Governor Ibrahim Shema of Katsina State, dey among dos wey dem attack, as dem dey go Visit Hajiya Dada wey bi the mama of the former Presido, Late Umar Musa Yar’Adua.
Tori tok say, as Presido Jonathan and ein pipo dey move enter dem Yar’Adua Compound, naim the youths wey carry broom for hand dey shout “Sai Buhari” con dey move towards dem.

No comments:

Post a Comment