Wednesday, 21 January 2015

Ebonyi Civil Servants don Start strike

                                  


According to News, Civil Servants for Ebonyi state, don start dia 3 days Warning today Wednesday, to take complain make Government improve the condition wey dem take dey do dia work.
Na the Chairmo of Trade Union Congress (TUC), for Labour Side, naim dey tell news pipo for Abakaliki say, the strike wey dey start on Wednesday January 21st and go end for Frida January 23rd.
Oga Nwafor tok say, Among wetin the workers dey ask for na, make Government pay dia September 2011 Workers Salaries give dem, as government no wan agree pay dem, sake of say, dem do strike dat period.
Ein con still tok say, the state Government neva still tok when dem go start to dey pay dem di new Minimum wage.

No comments:

Post a Comment