The Nigeria Security and Civil Defence Corps for Jigawa state, don
tok today say, dem don arrest one 30 years old man, wey tiff 8 goats.
Di state commandant, mr muhammed gidado, naim tell news pipo for
Dutse say, di suspect na person wey dey stay for Azarawa Village inside Babura
Local Government area of the state.
Oga Gidado say, the suspect go tiff the goatr from Achiya Village
wey dey for the same local Government area, but dem con catch am for Aujara
Village wey dey for Jahun Local Government.
The Commandant tok say, dem arrest-am as ein no fit give dem beta
explanation ontop how ein take get the goats wey dem catch-am with.
Dem con still explain say, after some kind investigation, dem see
say, the man dey among one group wey dey tiff pipo property for that area.
No comments:
Post a Comment