Wednesday, 21 January 2015

Flying Eagles beat NDC Warriors 6 Kondo

                             

The Flying Eagles for Kaduna on Tuesday, show say dem sef don step up dia Game, as dem con use ginger take dey prepare for the Super 6 Tournament wey go happen for Abuja dis weekend as dem use confidence win NDC Warriors 6 kondo.

The friendly match wey dem play for the Ahmadu Bello Stadium, wey Sunshine Stars’ striker Prince Aggrey  naim open the goal for Nigerian Under-20s after 13 minutes.
Ten minutes later, naim match skipper Taiwo Awoniyi win one penalty kick, wey na Ifeanyi Ifeanyi naim convert am to goal.
And more goals con follow after with other players for the team, wey show say, dem sef ready for any tournament wey go come for front.

No comments:

Post a Comment