Tuesday, 20 January 2015

Presidential Debate go start from January 28th



The Nigeria Election Debate Group don comot tok on Monday say, Na from January 28th to February 5th naim dem go Organise the Presidential Debate for dis year Election.
Na the Chairman of the Board of Trustees, Mr sola Omole, naim tell news pipo after dia board meeting wey former chairman of Daar Communications Plc, Chief Raymond Dokpesi, naim host-am.
Oga Omole tok say, the Director General of the Presidential Campaign Organisation of the 14 Candidates go open the floor on January 28th.
Ein con still tok say, the Vice Presidential debate go follow on the January 29th.

No comments:

Post a Comment