The working committee of peoples Democratic Party (PDP) for inside
Osun state, don sack one Mr Diran Odeyemi, wey be their Director of publicity.
Na the Secretary of the party for the state, Mr Bola Ajao,
naim tell news pipo for Osogbo on Monday.
Tori tok say, wetin make di party sack the man na say, even
with the plenty money problem wey the former Publicity man put ontop di
chairman, Alhaji Gani Olaoluwa.
For the statement wey the party carry comot after dia
meeting on manday, tok say, Mr Diran Odeyemi, no show say ein go fit continue
to do thing with the party, as na only fight and plenty excuse ein dey give.
No comments:
Post a Comment