The deputy Governor for Sokoto state, Alhaji Muktar Shagari,
Don promise on Monday say, dia pipo go vote for President Jonathan and Sambo
for the Presido Election Dis year February 14th.
Oga Shagari tok dis one for the PDP Presidential Campaign
Rally wey dem do for Sokoto say, Dem go make sure say dem vote for President
Goodluck Jonathan, to make ein continue beta Government for our Country.
Ein con still tok say, ein no get any plan to comot from PDP
to go join anoda Political Party dis period.
No comments:
Post a Comment