The Campaign Group of Governor Rochas Okorocha of Imo State, don accuse PDP say, dem neva talk truth of wetin make dem wan really collect power for Imo state, even as dem dey lie give President Goodluck Jonathan.
The statement wey na Sam Onwuemeodo, wey be the person wey dey incharge of Media for the group sign, tok say, even as dem as Group dey try do everything to make life beta for people and show beta example to oda political party, dey let Naija pipo know wetin dey really dey happen, as the PDP for Imo State and the PDP Governor Candidate, Hon. Emeka Ihedioha, just dey lie everywhere.
The group tok say, even as the election don dey near, PDP and Dia Candidate, Hon. Ihedioha, neva comot con tok wetin makje dem really wan enter Government inside the state for 2015.
Anoda mata na, say dem no even they tok anything about President Goodluck Jonathan and the Campaign wey ein dey do all around Nigeria.
No comments:
Post a Comment