Wednesday, 21 January 2015

Bangladesh Police don Arrest 7,000 Protesters


                   

Security pipo for Bangladesh say, dem don gbab more dan 7,000 opposition activist, since dem start di protest wey dem dey do for yonder for some days now.
According to tori, na more dan 29 pipo naim dis activist don kill, as dem carry plenty firebomb bus, cars and lories, as dem dey protest say, dem detain dia leader, Khaleda Zia.
The Industry Minister, Amir Hossain Amu, con dey tell news pipo for dia say, after ein sidon for one meeting for Dhaka say, na more dan 7,015 people dem don fit arrest inside the 15 days wey di protest don start.
The protest start aspolice give Zia office arrest, sake of say, she wan lead serious mass rally against her political rival, wey bi the Prime Minister, Sheikh Hasina.

No comments:

Post a Comment