Wednesday, 21 January 2015

INEC say na dem Get Ballot Boxes wey Police Seizee


                   

The Police Command for Ogun State don tok say, INEC don Confam give dem say, na dem get the Ballot boxes wey some Sojas Seizee for Benin-Sagamu Expressway.

Na the Tok-tok person for the command, Mr. Muyiwa Adejobi, naim tell news pipo on Tuesday for Abeokuta say, the Sojas wey dey for 35 Artillery Brigade, Ameokuta, naim seize the truck wey carry 3,600 bollot box inside.
Oga Adejobi tok say, the driver of the truck plus 2 oda passengers wey no fit tok how dem really take get the ballot box, naim dem handover to police for Ijebu-Ode Area Command.
Ein con tok say, after dem tok to INEC pipo, wey con finally confam say, na dem get the Ballot Boxes.

No comments:

Post a Comment