Tuesday, 20 January 2015

Mbu naim bi AIG incharge of Lagos, Ogun states

As the 2015 general elections don dey near, the Police High Command don transfer Mr. Mbu Joseph Mbu, former AIG Zone 7, Abuja and former Commissioner of Police  to Lagos, as the AIG wey go dey incharge of Zone 2 wey bi Lagos and Ogun States.

Anoda person, Mr. Tunde Ogunshakin wey bi former AIG in charge of Training and former CP Rivers State and CP in charge of Special Fraud Unit, naim dem redeployed go Rivers State as the AIG in charge of Zone 6, Calabar wey join Rivers State, Akwa Ibom State, Cross Rivers State.
Then AIG Tambari Mohammed naim bi the AIG in charge of Zone 1, Kano.
AIG Musa Daura dey incharge of Zone 5 Benin,  wey bi Edo, Delta and Bayelsa States.
AIG Aderenle Shinaba wey bi former CP Kano naim bi AIG in charge of Zone 4, Markudi.
AIG MOHAMMED J. ABUBAKAR dey in charge of ZONE 3 YOLA.
AIG. PATRICK D. DOKUMOR wey bi former directing Staff for NIPSS, JOS, naim bi the new AIG Zone 7, Abuja.

No comments:

Post a Comment