Monday, 19 January 2015

Police shoot teargas for Children Playground



According to tori, Police for Kenya don shoot tear gas give school children for one Big school wey dey for Nairobi, as the student dey do protest say, private developer don buy dia playground for the school.
The students just return to school after 2 weeks wey dia teachers take strike, wey dem for con see say, some pipo don fence dia playground, and the school wey get more dan 1,000 children between 3 years and 14 years and na Nairobi City Council naim dey run the school.
Tori say, plenty children naim wound from wetin Police do, and dem don carry dem go Hospital, to collect treatment.
Atleast one of the Police Officers wound for the mata, as one of the children stone-am for head.

No comments:

Post a Comment