Monday, 19 January 2015
Dem don see the Deadbody of one Big Lawyer for Argentina
Dem don see the dead body of one Federal Prosecutor for Argentina, Alberto Nisman, wey accuse the President, Cristina Fernandez de Kirchner, last week say she dey cover-up some kind mata for the Country.
Alberto Nisman bin dey investigate one bomb blast wey happen for one Jewish centre wey dey Buenos Aires for 1994, wey 85 pipo for die.
Na last Wednesday ein accuse di President say, she get hand for the plan to cover-up say, Iran no dey involve for the Bombing.
But the President tok-tok person say, the allegation na big lie e be.
Na the Mama of Mr. Nisman wey be 51 years, naim see ein deadbody for ein bathroom.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment