Monday, 19 January 2015

Houthi rebels don dey fight with army for Sanaa inside Yemen

Na serious fight dey between soja pipo and Shia Houthi rebels inside Sanaa wey bi di capital of Yemen, as we hear say dis same pipo attack di Presidential Palace and di Convoy of dia Prime Minister for di Country. The Rebels shoot the convoy of the Prime Minister, Khaled Bahan, as ein dey comot from one meeting wey ein and the President attend, but according to the information Minister for the country, non of dem wounjure for the attack. According to tori, the fight start early morning for Monday, wey dem dey talk say, naim be di serious challenge wey the Government of the country get for months now. This same rebel pipo, naim still take over di capital city, Sanaa, last year, before dem con sign deal with United Nations. The Shia Houthi Rebel bin sign under the government of President Abdrabbuh Mansour Hadi, say, dem go withdraw comot from the Capital city, after dem don form Unity Government for the Country.

No comments:

Post a Comment