Thursday, 19 February 2015

65 Yr Old Man tiff Cow and Ram of N830,000

http://www.vanguardngr.com/wp-content/uploads/2014/10/rams-epe.jpg 


According to Tori, Dem don charge one 65 years old man, Yahaya Bankole, go Ojo Magistrate Court for Lagos State say, ein tiff Ram and Cows wey reach N830,000.
Mr. Bankole wey be trader for Alaba Rago Market Lagos, dey face charge of say ein tiff, and the Prosecutor, ASP Godwin Eze, con dey tell the court say, the accuse bin tiff 9 Rams and 4 Cows for Ojo, Lagos on Decenber 22nd 2012 around 9:00 for Morning.
ASP Eze tok say, Bankole tiff the 9 Rams and 4 Cows fro  one Mr. Suleiman Olarenwaju, wey be dealer for the market.
Na when Bankole wan dey try sell the Animals wey ein tiff, naim dem take trace dem reach where ein dey, and the offence dey against Section 285 of the Criminal Law for Lagos State of 2011, and meanwhile the accuse don beg the court say ein dey guilty.
The Magistrate wey dey ontop the case, Mr Teslimi Shomade, don grant the man bail of N830,000 and  2 surety of the same money with 4 years tax clearance.
Dem postpone the case go March 23rd 2015.

No comments:

Post a Comment