No be small Confusion,
as the people of Umunneato autonomous community wey dey for Aboh Mbaise Local
Government Area of Imo State, just dey scatter everywhere, as dem see naked
deadbody of one woman from the community.
PidginDigest gather say, Dem see the
deadbody, day after everybody for the World celebrate Valentine day finish,
even for Okwu Village.
According to person wey see the
deadbody wey no greet ok ein name, ein tok say from wetin dem see for the body,
some kind mark dey the breast area and even the private parts, and dem no comot
mind from say, na gang-rape e go be wey happen to the woman, as dem no even fit
know the age or name of the woman soo.
The person tok say, dem no know how the
deadbody take reach where dem for see-am soo along the road for Okwu or who even
do-am.
The traditional ruler for the village,
Eze Leo Nwokocha, say, dem still dey try findout who the woman bi.
No comments:
Post a Comment