Monday, 2 February 2015

Buhari wan Drag NTA and AIT go Court



 

The Presidential Candidate of APC, Gen. Muhammadu Buhari (Rtd), don threaten say, ein go drag NTA and AIT go court, as dem dey show video wey tok bad about am.

Dis one comot, just as the Nigeria Broadcasting Commission (NBC), don warn all media house for the country say, make dem stop toi dey show wetin no dey for the Broadcast law for our Country, wey fit make NBC sanction any of dem.

For the protest letter wey the Legal Director of APC Presidential Campaign Council, Mr. Chukwuma-Machukwu Ume (SAN), carry comot wey Buhari for dey tok say, Make the 2 Television station stop to dey show the Video, and make dem comot come Apologize for Public.

Oga Buhari say, ein go take the mata go court, if the 2 Television station no gree come Apologize give-am.

No comments:

Post a Comment