The APC Presidential Campaign Organization (APCPCO), don comot con tok say, the office of Oga Presido Jonathan, dey plan to come show us fake Boko Haram Leader, to take show say, dem dey win the terrorist group for our country.
The Party con dey tok say, dem get warning from beta source say, the fake Shekau wey dem wan carry comot, fit be instrument wey dem wan use to take blackmail APC say, na dem dey pay for the plenty work wey Boko Haram don dey do to kill pipo for Naija.
APC tok say, this fake Shekau, fit comot con tok say, na Gen. Muhammadu Buhari ein dey work for, wey be big lie, so make Naija pipo shine dia eye, as dis na wetin Government go try wan do to fit win election for March 28th, 2015.
Na the Director onto Publicity for the group, Mallam Garba Shehu, naim con dey tok say, dem wan wonder where Government wan carry the fake Shekau comot, as dem bin don announce before say, dem don kill the Leader of Boko Haram Before now.
No comments:
Post a Comment