Sunday, 22 February 2015

I.S Group blow Bomb for Iran Embassy wey dey Tripoli

Image result for I.S


The Islamic State group(I.S), don blow 2 bomb for the empty house wey the Ambassador of Iran dey stay for Libya on Sunday.
One Security Person wey tell news pipo tok say, nobody wound for the attack wey shele for Tripoli, as plenty of the embassy-dem wey dey for the country don close since summer last year 2014, as militant group dey battle to take control of the city.

from wetin Issam al-Naass tok, one of the bomb blow near the security post, den the second blow inside the compound as nobody even dey for the building, and the security man wey suppose dey duty bin waka comot before dem blow the place.

I.S bin write for twitter say, na dem get hand for the bombing wey happen for the iran embassy wey dey for Tripoli.

No comments:

Post a Comment