Friday, 20 February 2015

Bayelsa Government wan do Special Burial for PDP Women Leader

Image result for PDP Woman leader who died in auto crash



According to Tori, The Government of Bayelsa State, don fix tomorrow wey bi Saturday, as the day for the Burial Ceremony of dat PDP Women leader, wey die along the East-West Road for Rivers State last week.
The Bayelsa State Government naim announce the Burial announcement after dem do private meeting with the family of the Woman.
PIdgin Digest hear fromFederal Road Safety Commission say, 9 inside the 11 pipo for the accident burn sotey, dem no fit recognise dem, wey make the state government to do mass burial give dem.
Bayelsa State Government say, dem go do service of songs for the Bayelsa Cultural Centre wey dey along Hospital Road, Yenagoa.












No comments:

Post a Comment