One Former Army Head of State, Gen. Abdulsalami Abubakar, don promise naija pipo say, make dem no fear at-all as nothing like interim Government go showface for our country.
Den the National Chiarmo of All Progressive Congress (APC), Chief John Oyegun, say nothing like fight or gbege go dey during the election for Nigeria, as far as, dem make all the electoral law stand without mago-mago.
Oga Abubakar wey be the chiarmo of the peace committee, wey na service chiefs, party and religion leaders dey inside, tell news pipo yesterday for the press conference say, with wetin president Jonathan don promise say, the election go still happen for March 28th and the Hand-Over for May 29th go still shele.
Ein con still advice party leaders say, make dem tell dia supporters make dem no spoil things during election, especially if dem no win.
No comments:
Post a Comment