Monday, 2 February 2015

AD Vice President Candidate get Motor Accident


                      



According to tori, No be small palava don knack the Presidential debate, as Vice presidential candidate of Alliance for Democracy (AD), Akuchie Clinton Cliff, bin dey involve for one Motor Accident, as ein dey go airport, to go attend the vice Presidential debate for Abuja Yesterday.

Still for yesterday too, anoda Vice Presidential Candidate, Hassanatu Hassan, of Citizens Popular Party (CPP), wey suppose go for the debate too, no showface, sake of the operation wey dem do give am.
Na the Coordinator of the 2015 Election Debate Group, Taiwo Alimi, naim dey announce am for the venue of the Debate, say the 2 candidate no go fit make sake of wetin dem dey go through, as dem don inform the organizers.
Meanwhile, some of dos wey dey for the debate, don tok say, na corruption for Nigeria, naim make Hunger and Unemployment don high well-well for our Country.

No comments:

Post a Comment