The Defence Headquarters don tok dis week wey e dey soo say, as dem dey do everything to flush out all the members of dat Boko Haram Group comot from Naija, dem don see say, some of the terrorist dey dress like woman, wey no go make pipo fit quick know dem well.
na the tok-tok person for defence Headquarter, Maj-Gen Chris Olukolade, naim con dey tok say, dem really don fit dey make progress, as dem don fit seizee plenty weapon and armunition wey the Boko Haram pipo hide for different places.
Ein say, even after all dos wey dem don fit catch, dem dey interrogate plenty of dem, but the Nigerian Air Force don really step up dia work to continue to dey bomb all dos area wey dem know say Boko Haram dey hold ground well-well like, Gwoza, Bama and Sambisa Forest, and drive everybody comot.
After Naija Army don fit save Baga from the hand of Boko Haram pipo, dia plan now na to fit make sure say, the pipo of dat area fit go back to dia village to dey live in peace again.
<script type="text/javascript" src="http://s7.addthis.com/js/250/addthis_widget.js"></script>
No comments:
Post a Comment