The Representative of United Nations, Staffan De Mistura, tok say, Damascus don ready to stop to dey blow bomb for Aleppo, for like six weeks to see how things go be for there.
The opposition Syrian National Council tok say, na only by action dem go fit take judge the government no be by word for mouth.
Tori tok say, Government army don really dey fight rebels, as dem dey try stop all the supply wey the Rebels dey get from international body.
According to wetin PidginDigets hear, na more dan 100 soja-men and rebels naim don die from the heavy shoot-shoot wey shele on Tuesday, as Army pipo take control of some village for the north side of the City.
No comments:
Post a Comment