Sunday, 22 February 2015

5 Yr Old Girl Blow Her Sef and 5 Pipo for Potiskum



Image result for girl suicide bomber
According to Tori, One 5 years old girl blow her sef with blow, and she kill 5 pipo join-am for one attack wey happen for one market wey dey for Potiskum, for the northeast area of Nigeria.
From wetin PidginDigest gather, 19 pipo sef con still wounjure for the attack, and dem dey for Hospital dey collect treatment now.

The informate wey come from one Hospital wey no gree tok dia name, tok say na around 1:30 for afternoon naim the attack happen, wey business dey plenty well-well.

Some of dos wey see the Girl before she blow the bomb tok say, na very small girl she be, wey mean say, dis boko haram pipo just wan dey use small chirldren wey no get sense or know anything. to do the killi-killi wey dem want for inside Naija.

Even as President Jonathan dey serious waka to come back for the position through the election wey go happen for March, e show say, serious plan suppose dey ground ontop security before dat time go come.

No comments:

Post a Comment